President Yoon Suk Yeol

Wia dis foto come from, Getty Images

3 December 2024, 16:03 WAT

New Informate one hour wey don pass

South Korea parliament don vote to block di president move to declare martial law, according to Yonhap and Reuters news agencies.

National Assembly Speaker Woo Won-sik bin submit a resolution requesting di lifting of martial law around 01:00 local time.

Di resolution bin pass with 190 of 300 members of di ruling and opposition parties in attendance, with all present in favour.

Di President of South Korea, Yoon Suk Yeol, bin declare martial law for one unannounced late night television address, e say di move dey necessary to protect di country from North Korea communist forces and to eliminate anti-state elements.

Di move come as Yoon People Power Party and di main opposition Democratic Party continue to disagree over next year budget bill.

Yoon say di decision dey made to remove pro-North Korea forces from di country and to protect di liberal constitutional order.

Yoon say e no get choice but to go to martial law, but e no tok for di address di specific measures wey go dey taken.

President Yoon Suk Yeol say e declare martial law in order to safeguard free and constitutional order.

“I declare martial law to protect di free Republic of Korea from di threat of North Korean communist forces, to fight di despicable pro-North Korean anti-state forces,” Yoon tok.

Reports America President Joe Biden administration dey in contact with di South Korean government and dey “monitor di situation closely”, one US national security council spokesperson tell BBC US partner CBS.

Biden never comment yet on im South Korean colleague declaration of martial law.

Di last time martial law bin dey declared for South Korea na for 1979 after di assassination of den dictator Park Chung Hee.

Martial law meaning

Police officers dey clash wit protesters outside South Korean National Assembly gate, afta di kontri president declare martial law.

Wia dis foto come from, Reuters

Martial law na temporary rule by military authorities in a time of emergency, wen dem conclude say di civil authorities dey unable to function.

Di implementation of martial law fit get legal impacts, such as di suspension of normal civil rights and di extension of military law.

Martial law in theory, dey temporary but e fit continue indefinitely.

Wetin di enforcement of martial law for mean for South Korea?

Police officers dey clash wit protesters outside South Korean National Assembly gate, afta di kontri president declare martial law.

Wia dis foto come from, Getty Images

According to di Yonhap news agency, those wey violate martial law fit dey arrested without warrant.

In addition, all media and publishers go dey under di martial law command and activities. And parliamentary activity dey banned.

Medical staff, including trainee doctors, don dey ordered to return to work in 48 hours, e add.

Opposition leader bin oppose di declaration

Chaos inside National Assembly as staff crowd into building

Wia dis foto come from, YONHAP NEWS AGENCY

South Korea main opposition, di Democratic Party, bin call on all im lawmakers to assemble for di National Assembly, di country legislative body, South Korea news agency Yonhap report.

Im leader, Lee Jae-myung, condemn di move as unconstitutional and call on di public to gather for di assembly, di report tok.

E call on all lawmakers from im Democratic Party to meet for parliament to vote down di declaration.

Di People’s Power Party leader Han Dong-hoon bin also call di declaration of martial law a “wrong” move, and don vow to block am.

President Yoon – wey declare martial law – na also a member of di PPP).

According to South Korean law, government must lift martial law if di majority of National Assembly demand am inside vote.

Di same law also stop martial law command from arresting lawmakers.

Who be Yoon Suk Yeol?

Yoon Suk Yeol

Wia dis foto come from, Reuters

Yoon Suk Yeol don be South Korea president since 2022.

E dey part of di People Power Party and win di presidential election by narrowly defeating im opponent, Lee Jae-myung, by just 0.7 percentage points. Dis na di closest election since South Korea start direct elections for 1987.

Di president don face low approval ratings due to various controversies and scandals, including those wey involve im wife, such as di alleged stock manipulation and allegedly accepting one luxury Dior handbag. Last month, Yoon apologise, say im wife suppose to conduct herself better.

Yoon also dey get tough time with pushing im agendas for parliament, wey dey controlled by di opposition.

Our eye still dey dis breaking tori and we dey update am.