Former govnors of Kano state Abdullahi Umar Ganduje, Rabiu Musa Kwankwaso and Govnor of Rivers State Siminalayi Fubara and former Govnor of Rivers, current minister of FCT, Nyesom Wike

Wia dis foto come from, Facebook/ Dr. Abdullahi Umar Ganduje OFR, Anadolu /Getty Images,

Wetin we call dis foto, Former govnors of Kano state Abdullahi Umar Ganduje, Rabiu Musa Kwankwaso and Govnor of Rivers State Siminalayi Fubara and former govnor of Rivers, current minister of FCT, Nyesom Wike

one hour wey don pass

Read am in 5 mins

Political fallout between sitting govnors and dia political godfathers don turn common pattern for Nigeria democracy.

Even though pipo dey expect such quarrel sometimes, few observers expect say relationship go spoil sharp sharp between former Rivers State govnor and current Minister of Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, and di man wey e help put for office as im successor, Govnor Siminalayi Fubara.

Fubara never even spend up to five months for office afta im inauguration on Monday, May 29, wen signs of serious crisis inside di state political structure burst enter public eye.

Di tension show face for di night of Sunday, October 29, 2023, afta reports say dem set Rivers State House of Assembly complex on fire amid moves wey link to alleged impeachment plot against di govnor.

Kontinu to dey read

By Monday morning, October 30, di situation escalate as Govnor Fubara reach di Assembly complex to check di damage.

Di drama wey dey happun for Rivers State don again draw attention to one common trend for Nigerian politics, wia alliance wey dem form during election dey collapse shortly afta power change hand.

E hapun during plenary wey dey presided over by Speaker of di Rivers State House of Assembly, Martin Amaewhule on Thursday 8 January, 2026.

Majority Leader, Rivers State House of Assembly, Major Jack, read out di notice of allegations and gross misconduct against Fubara.

Relying on Section 188 of di Nigerian Constitution, Jack list seven points of alleged gross misconduct against Fubara wey include:

Di demolition of di Assembly Complex.Extra budgetary spending.Withholding funds for di Assembly Service Commission.And refusal to obey di Supreme Court on di financial autonomy of di House and appointment of pesins to occupy positions in govment witout screening and confirmation by di Assembly among odas.

Twenty-six members of di Rivers State House of Assembly sign di notice afta di Majority leader Major Jack lay im notice bifor di Speaker.

Di speaker, Amaewhule say dem go serve di notice of impeachment to di Govnor in seven days.

Speaker, Martin Amaewhule say e bin don observe say Govnor Fubara never present a budget to di Assembly since di lifting of di state of emergency and e wonder wia e dey spend money from – even though di budget wey di National Assembly approve for 2025 under di Sole Administrator still dey run.

Also, Amaewhule say di Govnor dey appoint pipo into office witout screening and confirmation by di Assembly.

Several former govnors across di kontri don face similar fallout wit dia predecessors afta dem assume office. Below na some of dem:

Rabiu Kwankwaso vs Abdullahi Ganduje

For many years, former Kano State govnor Senator Rabiu Kwankwaso enjoy close relationship wit im successor, former govnor Abdullahi Ganduje.

Ganduje bin serve as Kwankwaso deputy two times, from 1999 to 2003 and again from 2011 to 2015. Dia alliance grow stronger between 2003 and 2007, wen Kwankwaso serve as Minister of Defence and Ganduje work closely wit am.

However, dia relationship begin spoil shortly afta Ganduje take office for 2015, wen e submit im cabinet list to di State House of Assembly for confirmation. Many of Kwankwaso loyalists feel say dem sideline dem, accuse Ganduje say e exclude dem from key positions.

Attempts to manage di tension fail, and di mata later turn full-blown rivalry. Dis one lead to di 2019 govnorship election, wia Kwankwaso-backed candidate, Kabiru Abba Yusuf, contest against Ganduje and lose under wetin many pipo describe as “controversial circumstances”.

Di fight kontinu enter di 2023 election, as Kwankwaso support Yusuf again, while Ganduje support Nasir Yusuf Gawuna. Even though Independent National Electoral Commission (Inec) first declare Yusuf winner, tribunal later cancel di result, and di case enta appeal.

Godwin Obaseki vs Adams Oshiomhole

Former Edo State govnor Godwin Obaseki also experience big fallout wit im predecessor and former mentor, Senator Adams Oshiomhole.

Obaseki, wey be key member of Oshiomhole cabinet, first get im support to contest and win di 2016 govnorship election under All Progressives Congress (APC).

Later, di relationship spoil wen Obaseki defect go Peoples Democratic Party (PDP) to pursue second term afta dem disqualify am from APC primaries.

Reports say Oshiomhole play role for Obaseki disqualification as dia rivalry dey grow, and e support Osagie Ize-Iyamu.

Despite all dis, Obaseki still win re-election, marking clear break from im former mentor.

Peter Odili vs Rotimi Amaechi

Former Rivers State govnor Dr Peter Odili for 2014 publicly express regret for supporting Rotimi Amaechi to becom govnor.

Odili accuse Amaechi say e scata di political structures wey PDP founding fathers build for di state once e enta office.

Amaechi, wey serve as govnor from 2007 to 2015, be close ally and political godson of Odili. As e reflect on im support, Odili tok say: “Wit all di best intentions, we support im political career and ambition. We tink say we do wetin best for di state. One tin clear, we don accept our mistake and we dey determined to correct am for 2015.”

Amaechi actions reshape Rivers State politics, and open road for alliance between Odili and Nyesom Wike, wey later help Wike becom govnor.