{"id":20781,"date":"2026-01-13T13:10:10","date_gmt":"2026-01-13T13:10:10","guid":{"rendered":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/20781\/"},"modified":"2026-01-13T13:10:10","modified_gmt":"2026-01-13T13:10:10","slug":"yoweri-museveni-ugandan-rebel-leader-turn-president-dey-contest-seventh-term-for-uganda-2026-elections","status":"publish","type":"post","link":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/20781\/","title":{"rendered":"Yoweri Museveni: Ugandan rebel leader turn president dey contest seventh term for Uganda 2026 elections"},"content":{"rendered":"<p><img fetchpriority=\"high\" decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-content\/uploads\/2026\/01\/1768245982_217_d7993380-ebf2-11f0-8608-ef259671aea9.jpg.webp.webp\"   alt=\"Museveni dey use on yellow microphone tok, e wear yellow coloured shirt\" loading=\"eager\" width=\"1500\" height=\"844\" style=\"aspect-ratio:1500 \/ 844\" class=\"css-1seqhu9\"\/><\/p>\n<p class=\"css-nyj3yn\" role=\"text\">Wia dis foto come from, AFP via Getty Images<\/p>\n<p>Article InformationAuthor, Wedaeli Chibelushi<\/p>\n<p>2 hours wey don pass<\/p>\n<p>Read am in 7 mins<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Ugandans under di age of 40 &#8211; and wey be more dan three-quarters of di population \u2013 don only see one president.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Yoweri Museveni seize di top job for 1986 afta one armed revolution and for di age of 81, e no dey show sign of stepping down.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Im time as leader follow long period of peace and significant development, for which many dey grateful. But im critics tok say e maintain im grip on power through mixture of sidelining opponents and compromising independent institutions.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;We no believe in [presidential] term limits,&#8221; e bin once tell BBC, secure in his role afta e win di election for di fifth time.<\/p>\n<p>Kontinu to dey read<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">A year later, e remove di age limit for presidential candidate \u2013 wey make way, many believe, for Museveni to bicom president for life.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Museveni journey start for 1944, wen dem born am into a family of cattle keepers for Ankole, western Uganda.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">E grow up during Uganda struggle for independence from UK, wey bin follow a period of brutality and turbulence under Milton Obote and Idi Amin.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">For many years, Museveni no sabi di date dem born am, e write for inside im memoir: &#8220;We bin get real life-threatening challenges like extra-judicial killings and looting\u2026 we no get time to worry about details like dates of birth.&#8221;<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">For 1967, Museveni comot Uganda to attend di University of Dar es Salaam for neighbouring Tanzania. For there, e study economics and political science and e forge alliances wit politically active students from around di region.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Museveni name gain prominence for 1970s, afta one coup by di notorious Idi Amin.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Museveni bin help form di Front for National Salvation &#8211; one of di rebel groups wey wit di help of Tanzania remove Oga Amin.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Oga Amin bin dey popular for crushing dissent and expelling di kontri Asian community. Under im eight-year rule, dem kill about 400,000 pipo.<\/p>\n<p><img decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-content\/uploads\/2026\/01\/1768207989_543_7a1c2310-ebf3-11f0-8608-ef259671aea9.jpg.webp.webp\"   alt=\"Old foto of Nelson Mandela dey follow Yoweri Museveni tok. E wear one of im signature wide-brimmed hats and a suit\" loading=\"lazy\" width=\"1024\" height=\"576\" style=\"aspect-ratio:1024 \/ 576\" class=\"css-1seqhu9\"\/><\/p>\n<p class=\"css-nyj3yn\" role=\"text\">Wia dis foto come from, AFP via Getty Images<\/p>\n<p>Wetin we call dis foto, Museveni, wear im trademark hat, wit Nelson Mandela for 1998<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;E bin dey part of di colonial system,&#8221; Museveni tell di Global Indian Network for one recent interview. &#8220;Idi Amin dey ignorant&#8230; a bit chauvinistic&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Following Amin fall, former President Milton Obote return to power through general election. However, Museveni refuse to accept Obote leadership, e claim say dem rig di vote.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">E launch one rebel struggle for 1981 and five years later, im rebel group, di National Resistance Movement (NRM), seize power and Museveni bicom leader.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Uganda economy begin to grow steadily and ova 10 years, di kontri see an average annual growth of more dan 6%.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Primary school enrolment double and HIV levels drop bicos of one anti-Aids campaign wey di president spearhead.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Museveni bicom di darling of di West, but im reputation drop for 1998, wen Uganda and Rwanda attack neighbouring Democratic Republic of Congo in support of rebels wey dey fight to overthrow di govment.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Around dis time, critics also complain say di president dey grow less tolerant of opposing views. E also bicom clear say im no get plans to leave power.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Museveni bin tok for one 1986 collection of writing: &#8220;Di problem of Africa in general, and Uganda in particular, no be dat of di pipo but leaders wey wan overstay for power.&#8221;<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">But by 2005, e be like say im view don change and Uganda constitution dey amended, wey remove di limitation on how many terms a president fit serve.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">For 2017, dem also remove di age limit for presidential candidates &#8211; a move wey bin lead to MPs throwing chairs for one chaotic parliamentary brawl.<\/p>\n<p><img decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-content\/uploads\/2026\/01\/8f4cc420-ef8f-11f0-b5f7-49f0357294ff.png.webp.webp\"   alt=\"BBC election graphics\" loading=\"lazy\" width=\"1500\" height=\"218\" style=\"aspect-ratio:1500 \/ 218\" class=\"css-1seqhu9\"\/><\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Museveni don also face allegations say e weaken di independence of key institutions.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">In particular, Uganda judiciary chop accuse say dem dey employ so-called &#8220;cadre judges&#8221; wey dia loyalty lie wit di govment.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Wen judges go against di govment, dem sometimes dey see themselves at loggerheads wit di authorities.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">For example, for December 2005, armed security personnel bin raid di High Court for di capital, Kampala, dem rearrest members of one suspected rebel group wey dem free from treason charges.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Di media independence also dey threatened. On di surface, Uganda get lively media industry, but dem don raid plenty organizations and detain several journalists.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Perhaps di most significant factor for Museveni longevity na di way e take subdue potential opposition forces.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Wen e bicom clear say Museveni no get plans to leave power, some of im former associates start to break away. As dem comot, security agencies turn dia attention on dem.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">For instance, Kizza Besigye of di opposition Forum for Democratic Change, na Museveni doctor bifor.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">E run against di president for 2001. Since then, dem don arrest and prosecute am plenty times.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">For 2024, e mysteriously disappear from Nairobi, only to appear four days later for one Ugandan military court. E still dey for jail on treason charges, wey e don deny.<\/p>\n<p><img decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-content\/uploads\/2026\/01\/1768207989_372_79f592d0-ebf4-11f0-8608-ef259671aea9.jpg.webp.webp\"   alt=\"One man wey wear shirt hold im arm up and dey shout as security agents dey try stop am\" loading=\"lazy\" width=\"1024\" height=\"576\" style=\"aspect-ratio:1024 \/ 576\" class=\"css-1seqhu9\"\/><\/p>\n<p class=\"css-nyj3yn\" role=\"text\">Wia dis foto come from, AFP via Getty Images<\/p>\n<p>Wetin we call dis foto, Uganda security forces dey accused of say dem dey arrest opposition supporters anyhow<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Di Pop star wey turn politician, Bobi Wine, na di latest Museveni critic to face di wrath of di state.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Di 43-year-old opposition leader, wey im star power draw huge crowds of youngsters, bin chop arrest, dem put am for prison and charge am wit crimes wey include treason. Dem later drop all di charges.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">For 2021, police tear-gas and even shoot Bobi Wine plus im supporters. Di police say e disobey coronavirus restrictions on large gatherings.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">During di current campaign period, security forces don use &#8220;firearms and live ammunition to scata peaceful assemblies&#8221; and abduct opposition party members in unmarked vans, one UN report tok.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">For di middle of dis, Museveni tell kontri pipo say &#8220;one soja dey carry 120 bullets&#8221;. However, e bin order police say make dem no beat opposition supporters but make dem use tear gas instead.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Museveni supporters point to di relative stability wey Uganda don enjoy for decades since e dey power.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Emmanuel Lumala Dombo, one tok-tok pesin for di NRM, tok say more dan 1.7 million pipo bin japa to Uganda afta dem run from di kasala wey dey happun for dia own countries.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;Forty years ago, we bin dey among di biggest exporters of refugees among di neighbouring countries wey surround us,&#8221; Dombo tell BBC. &#8220;Right now Uganda na di biggest host of refugees for Africa.&#8221;<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">One Museveni supporter wey bin surprisingly, turn up for one Bobi Wine rally tok di same thing.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Ndyasima Patrick tell BBC say im go vote for Museveni becos &#8220;na im keep us alive for all these years&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">E also dey respect Museveni age and e feel say Bobi Wine go only dey ready to lead Uganda wen e reach im 50s.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Museveni govment recently begin encourage foreign investment, as dem don strike deals wit di likes of China, di United Kingdom plus di United Arab Emirates. E say im want make Uganda bicom a middle-income country by 2040.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Museveni see imsef no be only as a stable, ambitious presence, but also as a nurturing figure for Uganda youth. E dey fondly call im young followers Bazukulu (wey mean grandchildren for di Luganda language) and dem dey call am wir nicknames M7 or Sevo.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">But wit eye on Bobi Wine, wey roughly be half of Museveni age, di president dey always show im vitality.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">For 2020, to encourage exercise during lockdown, dem feem am as e dey do press-ups, and e repeat di trick several times dat year, plus in front of cheering students.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">E don tok about im health on numerous occasions, late last year e say: &#8220;I don dey hia wit you for 40 years now. You don ever hear say I go hospital? Except wen I get [coronavirus] for 21 days.&#8221;<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">As Museveni ages, critics worry say e dey turn di kontri into im family affairs.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Dem note say di president wife, Janet, na di education minister and im son, Gen Muhoozi Kainerugaba na di head of di army.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Museveni grandson bin also enrol for di army for July, one move pipo see as say e dey extend di family dynasty.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Di NRM neva tok much on how dem plan to manage Museveni succession, but speculation full ground say im 51-year-old son, Gen Kainerugaba go take im place.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Should dis come to pass, e fit jeopardise Museveni legacy of stability. Pipo sabi Gen Kainerugaba as pesin wey dey unpredictable and provocative, especially on social media.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">E bin use X to joke about invading Kenya, rile Ethiopia by backing Egypt during one kwanta between di two countries, e also admit say e detain Bobi Wine bodyguard for im basement.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">At di moment, however, wit almost four decades of experience behind him, Museveni dey confident say im go win di election for di seventh time.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;Uganda dey secure. Go out and vote,&#8221; e tell di public during one New Year Eve address. &#8220;Di Ugandan NRM dey unstoppable.&#8221;<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Additional reporting by Sammy Awami<\/p>\n","protected":false},"excerpt":{"rendered":"Wia dis foto come from, AFP via Getty Images Article InformationAuthor, Wedaeli Chibelushi 2 hours wey don pass&hellip;\n","protected":false},"author":2,"featured_media":20782,"comment_status":"","ping_status":"","sticky":false,"template":"","format":"standard","meta":{"footnotes":""},"categories":[58],"tags":[153],"class_list":{"0":"post-20781","1":"post","2":"type-post","3":"status-publish","4":"format-standard","5":"has-post-thumbnail","7":"category-uganda","8":"tag-uganda"},"share_on_mastodon":{"url":"","error":""},"_links":{"self":[{"href":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-json\/wp\/v2\/posts\/20781","targetHints":{"allow":["GET"]}}],"collection":[{"href":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-json\/wp\/v2\/posts"}],"about":[{"href":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-json\/wp\/v2\/types\/post"}],"author":[{"embeddable":true,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-json\/wp\/v2\/users\/2"}],"replies":[{"embeddable":true,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-json\/wp\/v2\/comments?post=20781"}],"version-history":[{"count":0,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-json\/wp\/v2\/posts\/20781\/revisions"}],"wp:featuredmedia":[{"embeddable":true,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-json\/wp\/v2\/media\/20782"}],"wp:attachment":[{"href":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-json\/wp\/v2\/media?parent=20781"}],"wp:term":[{"taxonomy":"category","embeddable":true,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-json\/wp\/v2\/categories?post=20781"},{"taxonomy":"post_tag","embeddable":true,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/africa\/wp-json\/wp\/v2\/tags?post=20781"}],"curies":[{"name":"wp","href":"https:\/\/api.w.org\/{rel}","templated":true}]}}