{"id":247662,"date":"2025-12-23T14:02:25","date_gmt":"2025-12-23T14:02:25","guid":{"rendered":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/247662\/"},"modified":"2025-12-23T14:02:25","modified_gmt":"2025-12-23T14:02:25","slug":"weight-loss-drugs-wetin-go-hapun-wen-you-stop-to-take-am","status":"publish","type":"post","link":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/247662\/","title":{"rendered":"Weight loss drugs: Wetin go hapun wen you stop to take am?"},"content":{"rendered":"<p><img fetchpriority=\"high\" decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-content\/uploads\/2025\/12\/1766498544_784_b6ff6480-dcfe-11f0-aae2-2191c0e48a3b.jpg.webp.webp\"   alt=\"Collage foto of Ellen and Tanya dey look camera dey smile.\" loading=\"eager\" width=\"976\" height=\"549\" style=\"aspect-ratio:976 \/ 549\" class=\"css-1seqhu9\"\/>Wetin we call dis foto, Ellen and Tanya both lose weight with GLP-1 drugs, but dem get very different experience wen e come to stopping di medication<strong id=\"article-byline\" aria-hidden=\"true\" class=\"css-2ozlq5\">Article Information<\/strong><\/p>\n<ul class=\"css-1dlgp3z\">\n<li class=\"css-1kx8vrb\">\n<ul role=\"list\" class=\"css-1micfon\">\n<li class=\"css-k1irjw\">Author, Ruth Clegg , <\/li>\n<li class=\"css-k1irjw\">Role,  Health and wellbeing reporter, <\/li>\n<\/ul>\n<\/li>\n<li>\n<p>22 December 2025<\/p>\n<\/li>\n<li>\n<p>Read am in 7 mins<\/p>\n<\/li>\n<\/ul>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;E be like switch wey dem on, and sharp-sharp hunger go just catch you.&#8221;<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Tanya Hall don try stop di weight loss medicine plenty times. But anytime wey she stop di injections, di food noise dey come back loud well well.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Weight loss injections, or GLP-1s, don do for many pipo wetin diet never fit do. Di constant feeling wey dey tell dem make dem chop even wen dem don full, di drugs don switch am off.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Di medicine don give pipo wey never believe say dem fit lose weight a new bodi shape, new way to tink, and for plenty cases, a completely different life.<\/p>\n<p>Kontinu to dey read<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">But di question be say, you fit continue to take dem forever? Or you no fit? Well, na one of di big issues be dat nobodi really sure.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Na new drugs, dem be dem dey copy GLP-1, one natural hormone wey dey control hunger and di long-term side effects of using dem never clear well yet, na now-now dem dey start show.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">And wit about 1.5 million pipo for UK wey dey pay for di injections wit dia own money, staying on di drugs for long time no cheap at all.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">So wetin dey hapun wen pesin try stop?<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Two women, with two very different stories but di same goal &#8211; to lose weight and keep am off &#8211; tell us wetin dia experience don be like.<\/p>\n<p><img decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-content\/uploads\/2025\/12\/1766498544_505_57ed5810-dc42-11f0-b67b-690eb873de1b.jpg.webp.webp\"   alt=\"Collage foto of Tanya Hall wey show her weight loss journey\" loading=\"lazy\" width=\"976\" height=\"549\" style=\"aspect-ratio:976 \/ 549\" class=\"css-1seqhu9\"\/><\/p>\n<p class=\"css-nyj3yn\" role=\"text\">Wia dis foto come from, Tanya Hall<\/p>\n<p>Wetin we call dis foto, Tanya tok say her hair &#8220;dey fall out&#8221; wen she first start to take di drug<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;E be like say sometin open for my mind come tok say: &#8216;Chop everytin, no hold back, you deserve am bicos you don stay long witout food.'&#8221;<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Tanya, wey be sales manager for one big fitness company, first start to take Wegovy just to prove point. She dey overweight, she dey feel like &#8220;imposter&#8221;, and she believe say pipo for her industry no dey value her opinion sake of her bodi size.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">She ask herself say: dem go take me serious if I slim?<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">At di end, she tok say her fear come true. Afta she start to use di injections, pipo begin come meet her dey congratulate her for her weight loss. She feel say dem begin treat her wit more respect.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">But for di first few months of di treatment, Tanya no fit sleep well, she dey feel sick all di time, she get headache, and she even begin lose hair. Dis one fit no be directly from di drug, but e fit hapun wen pesin lose weight fast.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;My hair dey fall out well-well,&#8221; she remember. But for weight side, di result dey come as she want. &#8220;I don lose about three and half stone.&#8221;<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Now, more dan 18 months later, wetin start as small experiment don turn big life change. She don lose six stone (38kg) and she don try stop Wegovy plenty times.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">But evri time, just witin few days, she say she dey chop plenty food reach point wey she dey &#8220;completely horrified&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">So now di question be say, make she continue to take di drug and live wit all di side effects, or make she stop and enter di unknown?<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Wegovy company wey be Novo Nordisk tok say treatment decision suppose come from discussion between patient and healthcare provider, and say dem suppose consider side effects for inside di decision.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Lifestyle GP, Dr Hussain Al-Zubaidi, tok say stopping weight-loss drugs fit feel like &#8220;pesin just jump comot cliff&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;I dey always see patients wey go stop di drug wen dem reach di highest dose bicos dem don reach dia target weight, den dem go just stop,&#8221; im tok.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">According to Dr Al-Zubaidi, dat kain stop fit be like &#8220;avalanche or tsunami&#8221; hit pesin. Di food noise go come back sharp-sharp, sometimes from di next day.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">E say di evidence wey dey now show say between one to three years afta pesin stop di drug, plenty pipo go add weight back.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;About 60 to 80 percent of di weight wey you lose go come back,&#8221; im tok.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Ellen Ogley don decide say she no go make dat one hapun to her. She start to take weight-loss medication afta she reach one &#8220;turning point&#8221; for her life. She dey so overweight reach point wey she sign paper say she fit no survive one important operation.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">She say starting Mounjaro na her &#8220;last chance to get am right&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;I be emotional binge eater,&#8221; she tok.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;If I happy, I go binge. If I sad, I go still binge. E no mata wetin I dey feel, I no get control at all.&#8221;<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">But wen she start to use di injections, &#8220;all dat just switch off.&#8221;<\/p>\n<p><img decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-content\/uploads\/2025\/12\/1766498544_469_874ce080-dc42-11f0-a8dc-93c15fe68710.jpg.webp.webp\"   alt=\"Ellen dey look camera dey smiel\" loading=\"lazy\" width=\"1920\" height=\"1316\" style=\"aspect-ratio:1920 \/ 1316\" class=\"css-1seqhu9\"\/>Wetin we call dis foto, Ellen say she change her whole relationship wit food while she dey on weight-loss drugs<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Life witout food noise give Ellen chance to change how she dey see food. She begin read about nutrition and plan better diet wey go help her body get strength.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">She take di medication for 16 weeks bifor she begin reduce am small-small, cut am down witin six weeks. Altogether, she lose 3 stone 7 pounds (22kg).<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">As di weight dey go down, she notice say she fit exercise more. Any time wey she dey feel &#8220;low&#8221;, instead of &#8220;going to di cupboard go fill my face with food&#8221;, she go comot go run.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">But wen Ellen stop to take Mounjaro, she begin see di weight dey come back small-small, and she say e &#8220;scata her head small&#8221;.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Na why correct support important well-well, Dr Al-Zubaidi tok, <a href=\"https:\/\/www.nice.org.uk\/news\/articles\/people-need-support-to-keep-weight-off-after-treatment-ends\" class=\"focusIndicatorReducedWidth css-n8oauk e1h2ur550\" aria-label=\"for UK, di medicine watchdog, NICE, don recommend say patients, outside\" rel=\"nofollow noopener\" target=\"_blank\">for UK, di medicine watchdog, NICE, don recommend say patients<\/a> suppose get at least one year of follow-up advice and personal action plans after dem stop treatment. Di aim na to help dem change dia lifestyle so dem fit keep di weight off and most importantly, remain healthy.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">But for pipo wey dey pay for di drugs by demsef, like Tanya and Ellen, dis kain support no always dey guaranteed.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">For di past few months, Tanya weight no really change, and she feel say di drug no dey work like bifor. But she tok say she no go stop am.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">She don finally reach weight wey she dey comfortable wit, and evri time wey she try stop, di fear of adding weight back dey too much, so she go always find reason to return to di medication.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;For di first 38 years of my life, I dey overweight now I don lose six stone (38kg),&#8221; Tanya tok.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;So part of me dey feel like say e don turn addiction to continue am, bicos e dey make me feel good, e dey make me feel like say I get control.&#8221;<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">She pause small as she reason. Maybe na di oda way round, she tink say maybe na di drug dey control her.<\/p>\n<p><img decoding=\"async\" src=\"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-content\/uploads\/2025\/12\/1766498545_72_90c49540-dc42-11f0-aae2-2191c0e48a3b.jpg.webp.webp\"   alt=\"Collage foto show Ellen weight loss journey\" loading=\"lazy\" width=\"976\" height=\"549\" style=\"aspect-ratio:976 \/ 549\" class=\"css-1seqhu9\"\/><\/p>\n<p class=\"css-nyj3yn\" role=\"text\">Wia dis foto come from, Ellen<\/p>\n<p>Wetin we call dis foto, Ellen don continue to lose weight even afta she stop to take weight-loss medication<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;Na all about getting exit plan,&#8221; Dr Al-Zubaidi explain. &#8220;Di question be say: wetin be pipo experience once dem stop di injection?&#8221;<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">E dey worry say if no extra support for pipo wey dey try move comot from di drug, society unhealthy relationship wit food mean say notin much go change.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;Di environment wey pipo dey live for suppose promote good health, no be weight gain.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;Obesity no be GLP-1 deficiency,&#8221; im tok.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">For some ways, plenty pipo dey enter one kind weight-loss roulette wen e come to stop weight-loss drugs. Tins like lifestyle, support, mindset and timing dey affect how life go be after GLP-1 drugs.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Tanya decide say she go remain on di medication and she well-well sabi di good and bad side of dat decision.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">But for Ellen, she feel say dat chapter don close. She don lose more dan eight stone (51kg).<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">&#8220;I want make pipo know say life afta Mounjaro fit still work well,&#8221; she tok.<\/p>\n<p dir=\"ltr\" class=\"css-tmqcq9 e1yuyadm0\">Eli Lilly, di company wey dey make Mounjaro, tok say &#8220;patient safety na our number one priority&#8221;, and say dem dey actively monitor, check and report information to regulators and doctors.<\/p>\n","protected":false},"excerpt":{"rendered":"Wetin we call dis foto, Ellen and Tanya both lose weight with GLP-1 drugs, but dem get very&hellip;\n","protected":false},"author":2,"featured_media":247663,"comment_status":"","ping_status":"","sticky":false,"template":"","format":"standard","meta":{"footnotes":""},"categories":[274],"tags":[18,135,19,17,462],"class_list":{"0":"post-247662","1":"post","2":"type-post","3":"status-publish","4":"format-standard","5":"has-post-thumbnail","7":"category-medication","8":"tag-eire","9":"tag-health","10":"tag-ie","11":"tag-ireland","12":"tag-medication"},"share_on_mastodon":{"url":"https:\/\/pubeurope.com\/@ie\/115769255720686049","error":""},"_links":{"self":[{"href":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-json\/wp\/v2\/posts\/247662","targetHints":{"allow":["GET"]}}],"collection":[{"href":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-json\/wp\/v2\/posts"}],"about":[{"href":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-json\/wp\/v2\/types\/post"}],"author":[{"embeddable":true,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-json\/wp\/v2\/users\/2"}],"replies":[{"embeddable":true,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-json\/wp\/v2\/comments?post=247662"}],"version-history":[{"count":0,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-json\/wp\/v2\/posts\/247662\/revisions"}],"wp:featuredmedia":[{"embeddable":true,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-json\/wp\/v2\/media\/247663"}],"wp:attachment":[{"href":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-json\/wp\/v2\/media?parent=247662"}],"wp:term":[{"taxonomy":"category","embeddable":true,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-json\/wp\/v2\/categories?post=247662"},{"taxonomy":"post_tag","embeddable":true,"href":"https:\/\/www.europesays.com\/ie\/wp-json\/wp\/v2\/tags?post=247662"}],"curies":[{"name":"wp","href":"https:\/\/api.w.org\/{rel}","templated":true}]}}