Students dey reasin togeda

Wia dis foto come from, SDI Productions/Getty Images

    • Author, Ana Faguy
    • Role, BBC News, Washington DC
  • 19 August 2025, 10:10 WAT

    New Informate 25 minutes wey don pass

Di State Department don cancel more dan 6,000 international student visas becos of violations of US law and overstay, na wetin di department tell BBC.

Di agency say “majority of dem” of di violations na assault, driving under di influence (DUI), burglary and “support for terrorism”.

Dis move dey come as Trump administration kotinu to crackdown on immigration and international students.

While di State Department no explain wetin dem mean by “support for terrorism”, di Trump administration bin target some students wey bin protest in support of Palestine, according to am dem express antisemitic behaviour.

Students wear graduation caps

Wia dis foto come from, Getty Images

Out of di 6,000 student visas wey dem cancel, di State Department say about 4,000 of dem, dem cancel becos di visitors break di law.

Anoda 200-300 visas dem also revoke am sake of “terrorism wey dem do under INA 3B”, di State Department tok, dem refer to dis code wey dem define as “terrorist activity” mainly activities wey endanger human life or violate US law.

Earlier dis year, di Trump administration bin pause to schedule di visa appointments for international students. For June, wen dem restart di appointments, dem announce say dem go ask all applicants to make dia social media accounts public for enhanced screening.

Dem say dem go search for “any indications of hostility toward di citizens, culture, goment, institutions, or founding principles of di United States”.

Dem instruct State Department officers to screen for those “wey advocate for, aid, or support designated foreign terrorists and oda threats to national security; or who perpetrate unlawful anti-Semitic harassment or violence”.

For May, Secretary of State Marco Rubio tell lawmakers say from im estimation say dem cancel “thousands” of student visas since January.

“I no know di latest count, but we probably get more to do,” Rubio tell US lawmakers on 20 May. “We go kotinu to cancel di visas of pipo wey dey hia as guests and dey disrupte our higher education facilities.”

Democrats don push back against di Trump administration effort to cancel student visas, dem describe am as an attack to due process.

More dan 1.1 million international students from ova 210 kontris enrol for US colleges for 2023-24 school year, according to Open Doors, one organisation wey dey collect data on foreign students.