A Cloudflare logo on a mobile phone

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Liv McMahon
    • Role, Technology reporter
  • 18 November 2025, 14:34 WAT

    New Informate 3 hours wey don pass

Some high-profile websites, wey include X and ChatGPT, don go down for some users sake of problems wey dey affect major internet infrastructure firm, Cloudflare.

Thousands of users report issues wit X and oda services to outage monitoring site Downdetector shortly afta 11:30 GMT on Tuesday.

On dia homepage, X show one message wey say problem dey wit dia internal server, sake of one “error” wey come from Cloudflare.

ChatGPT site also dey show error message wey dey tell some users: “please unblock challenges cloudflare.com to proceed.”

“Cloudflare dey aware of, and dey investigate one issue wey don affect multiple customers,” di company tok for one note on dia service status dashboard at 11:48 UTC.

For subsequent update, di company say dem dey “see services recover” but add say customers “fit continue to observe higher-dan-normal error rates as we continue remediation efforts”.

Dis suggest say some platforms fit continue to experience issues as di company dey work to resolve di technical problems dem get.

Cloudflare na big provider of internet security across di world, dem dey carry out services like checking visitor connections to sites wey dey come from humans rather dan bots.

Dem say 20% of all websites worldwide dey use dia services in some form.

E neva dey clear which and how many of dos websites dey affected by dis outage, and to which extent.

However, some users dey report say di problems dey affect oda high-profile platforms, including OpenAI chatbot ChatGPT.

Downdetector sef – one site wey many users dey visit wen sites stop to dey load or appear to get issues – also show one error message as many pipo dey try to access am on Tuesday.

OpenAI tok say dem dey investigate dos issues but dem no say if e dey related to Cloudflare.

Issues wey dey affect Cloudflare services come afta one outage wey affect Amazon Web Services last month see more dan 1,000 sites and apps knock offline.

Anoda major web services provider, Microsoft Azure, bin also dey affected shortly after.

Some experts suggest say dis kain incidents highlight how modern internet dey fragile, and di serious kasala wey e fit cause small-small companies under am.