A collage of damaged buildings and a missile26 December 2025, 14:03 WAT

New Informate 17 minutes wey don pass

Read am in 2 mins

US President Donald Trump bin launch “powerful and deadly strike” against di Islamic State for Nigeria but e also hit Offa area of Kwara State.

Tajudeen Alabi, wey be former Special Assistant to Kwara State govnor on security matas confam di incident to di BBC.

Alabi say dem hear sound three times around 9pm on 25 December.

Di former Special Assistant say di strike hit and destroy buildings for several locations but as of now, dem neva report any casualty.

Kontinu to dey read

“At least, na about five structures destroy for different locations. We see some items for one popular hotel, we dey call am Offa Central Hotel. E be like bomb,” e tok.

Nigeria confam airstrikes on terrorist targets

Nigeria Ministry of Foreign Affairs wey also confam di strikes say dem collaborate wit America to carry am out.

For statement ontop dia X account, di ministry say Nigeria dey cooperate wit international partners including America to address di threat of terrorism and violent extremism.

Dem say di collabo lead to “precision hits on terrorist targets for Nigeria and by air strikes for di north west.

“In line wit established international practice and bilateral understandings, dis cooperation include di exchange of intelligence, strategic coordination and oda forms of support wey dey consistent wit international law, mutual respect for sovereignty and shared commitments to regional and global security.” Di statement add.

Di statement go further to say di counter-terrorism efforts dey guided by: ” Di primacy of protecting civilian lives, safeguarding national unity and upholding di rights and dignity of all citizens, irrespective of faith or ethnicity.”

Photo of a missile Damaged buildingDamaged buildingDamaged building