
Wia dis foto come from, Getty Images
Article Information
-
7 hours wey don pass
-
Read am in 4 mins
US President Donald Trump tok say im dey “perfect” health, as im dey take more aspirin pass wetin doctors recommend, im dey use makeup to cover di bruises on im hands, and im no dey do regular exercise bicos e find am “boring”.
For inside one lengthy interview about im health, Trump also tell The Wall Street Journal say im bin do one CT scan for October, afta e mistakenly tell tori pipo say im undergo more detailed MRI scan.
79-year-old Trump na di oldest president wey dem go elect for US history, and signs of age don begin show.
E don appear to fall asleep for some meetings and no dey fit hear questions.
Kontinu to dey read
Di Journal say Trump “no like public debate on top im health”.
“Make we tok about health again for di 25th time,” e tok for di start of one “impromptu phone call” as di newspaper bin dey prepare to publish one story about Trump health.
Trump tok say im dey take larger dan recommended doses of aspirin for di last 25 years, even as e tok say e dey make am to bruise easily.
“Dem say aspirin dey good for thinning out di blood, and I no want thick blood pouring through my heart,” Trump tok.
E dey take 325mg of aspirin per day, instead of di 81mg dose wey doctors sometimes dey recommend doctors.
“Di doctors go rather allow me take di smaller one,” Trump tok.
But e no wan switch routines afta so many years. “I dey a little superstitious,” e tok.
Di president bin also tok about di medical scan e receive for Walter Reed National Medical Center, wey e tok bifor say na MRI scan.
“No be MRI,” Trump tell di Journal. “E no reach dat level. Na scan.”
One doctor for Trump, Navy Capt Sean Barbaella, for one statement wey dem give di Journal say Trump bin undergo one CT scan, “to definitively rule out any cardiovascular issues” e add say di testing no show any abnormalities.
Afta Trump bin dey diagnosed wit chronic venous insufficiency, one common condition for older people, dem advise am to dey wear compression socks but e refuse.
“I no like dem,” Trump tok, e say now im dey get up from im desk more regularly, wey don improve swelling for im legs.
Still, di president say im prefer not to do any form of regular exercise, apart from golfing.
“I just no like am. E dey boring,” Trump tok. “To dey waka on treadmill or dey run on treadmill for hours and hours like some pipo dey do, I no dey for dat one.”
Di president repeat am say im no dey dose off during public meetings, e say im dey close im eyes at times bicos e find am “relaxing”. As for di bruises pipo dey see on im hands for some fotos, Trump say im dey carry makeup now in case im hand get “whacked”.
“I get makeup wey dey easy to put on, e dey take about 10 seconds,” e tok.
Trump say im no get trouble wit im hearing, and e say dos places wia photographers tok fotos of am wia e appear like say im dey sleep, e say “sometimes dem dey take foto of me blinking”.
“And dem go catch me wit di blink.”
Barbabella tok for di statement to di Journal say Trump dey in “exceptional health and perfectly suited to execute im duties as Commander in Chief”.
Play video, “Trump says his recent MRI scan was ‘perfect'”, Duration 0,4200:42
Wetin we call dis Video, From October: Trump say im recent MRI scan dey ‘perfect’