
Wia dis foto come from, GHANA MUSIC AWARDS
Wetin we call dis foto, Black Sherif tank im family and fans wey im promise dem more music afta dem declare am artiste of di year9 May 2026
New Informate 2 hours wey don pass
Read am in 3 mins
Mohammed Ismail Sherif wey im stage name be Black Sherif aka Blacko don win Ghana music awards artiste of di year 2026.
Dis be afta im beat five odas for di tense awards show wey happun for di Accra International Conference Centre on Saturday.
Black Sherif also pick up three oda awards on di night.
Di ‘Sacrifice’ hitmaker win di ogbonge award for only di second time afta im win artiste of di year for 2023.
Kontinu to dey read
Blacko beat competition from Medikal wey bin win three awards on di night.
Medikal carry im monster hit song ‘Shoulder ft Shatta Wale, Beeztrap’ to win Hiplife song of di year, best collaboration of di year and most popular song of di year.
Di 24-year-old im ‘Iron Boy’ album wey im release for 3 April 2025 win album of di year.
Black Sherif im song ‘Sacrifice’ on top di album also win Afropop song of di year.
Anoda song from di album (Where Dem Boys) also win Hiphop song of di year.
Di musician also win song writer of di year award.
Afta im pick di ultimate award, Black Sherif tank im fans and family for dia support.
“Make God bless everibodi wey dey listen my songs, I love you all. I also dedicate dis song to all my fans,” Black Sherif tok.
Im promise im fans say more music dey road top dey come.
Oda nominees for di artiste of di year category like Wendy Shay win Afrobeats/Afropop artiste of di year.
Stonebwoy wey don win artiste of di year two times (2015 and 2024), win Reggae/Dancehall artiste of di year for di 10th time.
Gospel musician Diana Hamilton win gospel artiste of di year.

Wia dis foto come from, MEDIKAL/STONEBWOY/KOFI KINAATA
Wetin we call dis foto, Medikal (L) win four awards (Hiplife song, best collaboration, most popular song and best hiphop/hiplife artiste), Stonebwoy (M) win Reggae/Dancehall artiste of di year wey Kofi Kinaata (R) win Highlife song and highlife artiste of di year.
Full list of winners
Medikal Ft. Shatta Wale & Beeztrap KOTM – Shoulder
Best Hiplife/Hip-hop Artiste of the Year
Best Highlife Artiste of the Year
Best Female Vocal Performance of the Year
Best Highlife Song of the Year
Kofi Kinaata – It is Finished
Best Traditional Gospel Song
Piesie Esther – Nyame Ye
Best HipHop Song of the Year
Black Sherif – Where Dem Boys
Best Afrobeats Song of the Year
Kojo Blakk Ft Kelvin Boy – Excellent
Best Afropop Song of the Year
Black Sherif – Sacrifice
Best Music Video of the Year
AraTheJay – Put am on God
Best Male Vocal Performance of the Year
Best Afrobeats/AfroPop Artiste of the Year
Best Rap Performance of the Year
Best Highlife Artiste of the Year

Wia dis foto come from, DIANA HAMILTON/WENDY SHAY/PIESIE ESTHER
Wetin we call dis foto, Diana Hamilton (L) win Gospel artiste of di year, Wendy Shay (M) win Afrobeats/Afropop artiste of di year wey Piesie Esther (R) win Best traditional gospel song of di year.
Black Sherif – Sacrifice
Collaboration of the Year
Medikal Ft Shatta Wale & Beeztrap – Shoulder
International Collaboration of the Year
Moliy Ft Shenseea, Skillbeng & Silent Addy – Shake it to the Max
Best Urban/Contemporary Gospel Song of the Year
Kofi Owusu Peprah – Big God Afro
Best Reggae/Dancehall Artiste of the Year
Best Gospel Artiste of the Year
Iron Boy – Black Sherif
Most Popular Song of the Year
Medikal Ft Shatta Wale & Beeztrap – Shoulder
Reggae/Dancehall song of the year
Moliy Ft Shenseea, Skillbeng & Silent Addy – Shake it to the Max
Best New Artiste of the Year
Kwabena Kwabena – Enso Nyame Y3
Audio Engineer of the Year Nominees
Daniel Grull – Enso Nyame Y3
Lali x Lola (Crox it out breast cancer awareness song)
Davido ft Omah Lay – With you